EFCC dey try disgrace us - Dangote Group

Aliko Dangote

Wia dis foto come from, Dangote Group

One of di biggest business joinbodi for Africa, Dangote Group don confam say Nigeria anti-corruption police, di Economic Financial Crimes Commission (EFCC) bin raid dia office.

For statement wey dem drop late Saturday, e tok say di raid by members of di EFCC na just plan to embarrass di company.

Di statement add say di company don already answer EFCC request to show dem documents on how dem take dey get dia foreign exchange.

EFCC neva drop any statement on top di mata, but one source for di commission tell BBC say EFCC dey torchlight di books of di Dangote Group as part of wider investigation wey involve di suspected abuse of foreign currency allocations by Nigeria Central Bank.

Dangote Group na collabo of companies wey dey owned by di richest man for Africa, Aliko Dangote.

Na on Wednesday 3 January, officers of di Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) bin burst enta di headquarters of di Dangote Group for Lagos, southwest Nigeria and block di entrance to di building.

For wetin some pipo don call "very unusual" move by di agency.

Company staff wey see as di mata dey happun tell BBC say, di EFCC bin demand to see di Group Managing Director for Dangote Cement, Arvind Pathak wey bin no dey around, afta dem hear dat one, dem come force staff to open im office.

For dia statement, Dangote Group tok say dia representative bin don go di agency office to deliver di first batch of documents wey dem ask for, but EFCC officers say dem wan come dia office to collect di same documents instead.

Wetin happun during di Dangote raid?

Di statement wey Anthony Chiejina, Dangote Group Chief Corporate Communications Officer give BBC tok say, "On 6 December 2023, we get letter wey ask for di details of all di foreign exchange wey don dey allcated to our company by Central Bank of Nigeria from 2014 to now. We ansa EFCC to show say we get di letter and also ask which of di companies for inside di group dem bin want dat kain informate on.

"We bin also ask for more time to fit gada and properly present di plenti document of ten years give dem. But EFCC no give di clarification and no give is more time sat make wey present di documents for di time wey dem tok."

Sources bin don gist BBC before say, Gbenga Fapohunda wey be di acting Group Chief Financial Officer bin don go EFCC office wit di documents before di raid start.

Di EFCC officers later comot di building wen dia office call dem (as di documents wey dem dey find don already land for dia office).

Tori be say EFCC hold di CFO oga Fapohunda till 9:30pm for Thursday for questioning before dem release am and demand make e bring more documents.

Why di raid happun?

Apart from Dangote Group wey be one of di biggest business combinations for Africa, tori be say di EFCC don write letter give 51 oda companies.

Di letters dey ask di companies make dem supply documents wey support di allocation and use of foreign currencies to dem in di last ten years.

All dis tins dey happun as di Nigerian Naira don dey fall like stone. Di fall in value of di Naira don increase inflation more than usual and cause economic palava for di kontri.

Some of dis wahala dey seen as di fault of di abuse of foreign currency allocation wey don lead to kurukere selling and buying of forex and di different exchange rates wey di kontri get.

Comments

Keep up to date with our latest articles and uploads...